Jeremaya 18:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
13 God still sey, “Ask di oda nashon if dis kind tin don ever happen before. Israel pipol for bi like woman wey neva ever sleep with man wons, but dem don really do wiked tins.
E get anybody wey don hear or si dat kind tin before? E don get any town wey dem use one day make? So, Zion nor go sofa tey again, before I go bring am kom back to life.
But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.
Fear katch Filistia pipol, bikos dem fill sey difren gods don enter Israel kamp. Dem kon sey, “Dis one bad for us! Wi neva si anytin like dis before o-o!