Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 17:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 17:16
21 Iomraidhean Croise  

But my God, Yu know mi! Yu dey si evritin wey I dey do and how I love Yu rish. Make Yu take dis wiked pipol komot like sheep wey dem won go kill. Tell us wen dem go die.


But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”


Den I ansa, “My God! Yu know as I dey sofa. Abeg make Yu remember kon help mi. Make Yu revensh doz wey dey tok bad against mi. Nor sorry for dem, so dat dem nor go kill mi. Make Yu remember sey na bikos of Yu, dem dey curse mi.


Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.


My God, Yu don deceive mi! Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet? Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well. Naw, evribody dey look and laf mi.


But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.


I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.


Una nor like anybody wey dey judge well or tok trut for kourt.


Una know sey I nor stop to dey tell una anytin wey go help una and I tish una for publik and for una house.


Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.


My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.


My brodas and sistas, evribody nor go fit bi tisha, bikos yu know sey wi wey dey tish, na awa judgement go big pass,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan