make Yu hear dia prayer and listin to dem from where Yu dey for heaven. Make Yu forgive and help dem. Na only Yu know wetin human being dey tink. Make Yu ponish or bless anybody as e fit am,
Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.
I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
make Yu listin to dem from heaven; forgive dia sin kon ansa each pesin akordin to wetin Yu tink sey dey en mind. (True-true, na only Yu fit really know wetin pesin dey tink.)
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
So I pray to God: “My Oga God wey dey rule all of us; yor judgement na true and Yu dey si wetin pipol dey tink for dia heart. Make Yu fight dis pipol for mi, bikos my life dey yor hand.”
My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”
My God wey dey mighty; Yu dey give korrect judgement to pipol and Yu know wetin dey dia heart and mind. So, make I si how Yu won take revensh my enemies, bikos I don put my problem for yor hand.
Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”