E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
No amount of soap wey una go take wosh una sin, go fit make una klean, bikos I still dey si all di wiked tins wey una dey do.” Mi, wey bi God, don tok.
Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.” Dis na wetin God tok.
God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.
Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.