di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”
I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”
But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
Nashons and kings go kare for una as mama dey kare for en pikin. Den, una go know sey, mi wey bi God, don save una. Israel God wey get pawa don free una.
But di Pesin wey go save dem, dey strong. Dem dey koll am Oga God wey dey rule ova evritin. E go fight for dem kon bring peace and rest kom di eart, but na trobol, wahala and pain go follow Babilon pipol.”
Di king kon tell dem, “But I dey si anoda pesin for der, dem nor tie am and e just dey waka round di fire! Nor-tin don happen to dem! And di nomba four pesin bi like angel!”