But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
Dem don already separate demsef from all di strenjas. Dem wear sak klot kon pak dust for dia head as sign sey dem dey sorry. Den dem kon stand dey konfess dia sins wey dem and dia grand-grand papa don kommit.
Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.
But make una first gri sey una don sin against mi wey bi di Oga una God. Make una konfess sey una nor dey obey my kommand and una don show una love to oda gods for under evry green tree.” Mi, wey bi God, don tok.
So make wi liedan with shame! Make awa disgrace kover us. Wi and awa grand-grand papa don sin against di Oga awa God. Since wi dey yong kon rish naw, wi nor gri obey di Oga awa God.”
Di pipol kon ask demsef, “Wetin make us just sidan for here? Make wi run go di strong towns, so dat even if wi go die, den wi go fight die for der. Since di Oga awa God don sey wi go die; E don give us poizin drink, bikos wi sin against am.
So my God, make Yu si as I dey sofa! My heart dey kry, bikos of my sins. Dem dey kill pipol for di street and even deat dey inside house too dey wait mi.
“Naw, awa God, na Yu take yor pipol komot from Egypt with yor mighty pawa kon make name for yorsef wey dem nor fit forget forever. Wi don sin and wi dey bihave like wiked pipol.
For my vishon, I si di lokust dey chop all di plant wey dey grow for di land, so I sey, “God wey get pawa, I beg, make Yu forgive us; wi nor go survive dis wahala bikos wi nor plenty and wi weak well-well.”