Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 14:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 14:19
26 Iomraidhean Croise  

But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.


Na happiness and lite I dey hope for, but na trobol and darkness I kom get.


Wen God hear dem, E kon dey vex and E really rijet Israel pipol.


But naw, God, Yu don rijet and porshu David shidren-shidren. Yu dey vex with di king wey Yu anoint.


If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.


God still sey, “I don forget Israel pipol and rijet di nashon wey I choose. Doz wey I love, I don give dem to dia enemies.


Pipol wey I koll my own don turn against mi like lion for forest; di way dem dey tok to mi, bi like wen lion dey shaut. So I go trit dem like sey I hate dem.


Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


So, wetin make mi still dey sofa? Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure? Yu dey plan to leave mi like stream wey dry?”


God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.


Nobody go kare for una or cure una sore; una nor get hope at-all.


Mi, God wey dey mighty, neva forget Israel and Judah pipol, even doh dem sin against mi wey bi di holy God for Israel.


Dem go koll dem yuzles silva, bikos mi wey bi God, don rijet dem.


So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”


Even wen wi pray for peace, na wahala dey follow us. Wi bilive sey wi go rest small, but na trobol dey porshu us.


Medicine nor dey Gilead again? Doctors don finish for here? If dem dey, wetin make dem neva cure my pipol?


Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?


Just as dem dey invite pesin for party, na so too Yu invite my enemies and I kon dey fear. For di day wey God dey vex, nobody go fit eskape or survive am. Naw, my enemies don kill all di shidren wey I born and train.


Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.


Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?


True-true Marot pipol dey wait for who go save dem, but God don bring wahala kom Jerusalem.


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan