But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”
God still sey, “Ask di oda nashon if dis kind tin don ever happen before. Israel pipol for bi like woman wey neva ever sleep with man wons, but dem don really do wiked tins.
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.
Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?
Jerusalem wall wey fine well-well, make yu kry give God! Both day and nite, make di wota from yor eye dey flow like river! Make yu nor rest or stop to kry!