Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 14:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 But God ansa, “Doz profet dey lie with my name; I nor send dem or tell dem sey make dem tell di pipol anytin. Nor bi mi give dem di vishon wey dem dey tok about and wetin dem tok, na di yuzles tins wey dem tink for dia own mind.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 14:14
32 Iomraidhean Croise  

E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!


Na di old pipol and rulers, bi di head, while di tail, na di profet wey dey lie waka.


Pashhur! Dem go karry yu with yor family go Babilon. Yu go die and yu with all yor friends wey yu lie give, dem go beri una for der.’ ”


den e tok for evribody present sey, “God sey dis na how e go take break di load wey King Nebukadnezzar put for di nashons neck and E go do am before two years go finish.” So Profet Jeremaya kon waka go.


I go tell Hananaya: “Yu don really break di yoke wey dem make with wood, but naw, na iron yoke yu don put for where e bin dey.


Den I tell Hananaya, “Make yu listin to mi! God nor send yu and yu dey make dis pipol bilive yor lie-lie story.


“Dis na wetin Israel God wey dey mighty tok about Ahab wey bi Kolaya pikin and Zedekaya wey Maaseaya born, wey dey lie for una with God name. God sey, ‘I don give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and e go kill dem for una present.’


“Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una.


Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


So, I go give dia wifes to oda men kon give dia farm to oda pipol. I go do am, bikos both rish and poor pipol dey use wayo take dey get dia money. Even profets and priests don join dey deceive pipol too.


Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Even wen dem know sey nor bi so e go bi.


Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.


Di town gates don sink enter groun. E skata all di keys and bars wey dem take dey lock di gates. Dem take en prince dem and kings go Babilon as slave. Law nor dey again and God profets nor dey get any vishon from am again.


Bikos dat time, di yeye vishon or words wey Israel pipol dey tok, nor go dey again.


“Man pikin, make yu tok against di profets for Israel. Profets wey dey tell pipol anytin wey dem like. Go tell dem sey: ‘Make una hear God word!


So una lie-lie vishon, don end. I go save my pipol from una pawa, so dat una go know sey na mi bi God.”


Di vishons wey una si nor bi true and wetin una sey go happen, na lie. Una dey evil and wiked well-well and una day dey kom; di day wey God go ponish una, den di swod go kut una neck komot.


Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”


Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.


But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.


But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.


Dis pipol dey lie and na wayo dem sabi do and dia mind don skata.


My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan