Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 13:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 “Na so I go take distroy Judah and Jerusalem pipol pride.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 13:9
19 Iomraidhean Croise  

Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.


Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up. Wi know sey di pipol sturbon well-well, but na empty mout dem just dey make.”


Na God wey dey lead heaven sojas do am. E do am to stop dia pride and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.


I go make Jerusalem and all di towns for Judah, dia kings and all dia ofisas drink from am, so dat di land go turn to desert, where dem dey trow dirty put and wen pipol si am, dem go shok with fear. Den pipol go use dia name dey curse pipol, just as dem don already dey use am.


Moab pipol too dey proud! I don hear as dem proud and sturbon rish and how dem dey tink of demsef alone.


Dem proud and sturbon kon dey do tins wey I nor like and na dis make mi distroy dem, just as all of yu know.


Dat time wey yu dey proud, shebi yu dey laf Sodom


I go break una strong pride; una nor go get rain; una land go dry kon strong like iron.


Judah and Israel pipol bi like tree wey en enemies break en branches, but Oga God go make dem grow again kon give dem glory and pawa.


For dat day, una nor go dey shame bikos of all una sturbones against mi. I go distroy doz wey dey boast among una and una nor go ever dey sturbon for my holy hill again.


“I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”


But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan