King Ahaz send message go give King Tiglat-Pileser for Assyria sey, “I bi yor savant and I trust yu well-well. Abeg, make yu kom save mi from Siria and Israel king, bikos dem dey attack mi.”
Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?
Israel pipol, make una nor let una shoe skata or allow una troat dry as una dey run follow oda gods. But una sey, “No! Wi nor go fit go back. Wi love dis gods and wi go follow dem.”
Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?
‘For di vishon, I si sey, dem karry all di wimen wey remain for Judah royal palis go meet Babilon ofisas and dis na wetin dem dey tell di king: “ ‘ “Na yor best friends give yu wrong advise, dem dey kontrol yu and naw wey yu don enter trobol, all of dem don run leave yu.” ’ ”
Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
Wen dem dey kom kill yu, yu go still tok sey yu bi god? By di time yu go si di pipol wey won kill yu, yu go know sey yu nor bi god, but na ordinary human being yu bi.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.