2 So, I kon go buy and wear am just as Oga God tok.
Make yu always dey trust God with all yor heart, but nor trust wetin yu tink sey yu know.
For dat time, God tok to Isaya wey bi Amos pikin sey, “Make yu remove di sak wey yu wear and di sandal wey dey yor leg.” So e obey God kon waka naked without sandal for leg too.
Den God tell mi again sey,
Man pikin, make yu listin to wetin I go tell yu. Make yu nor sturbon like dem. Naw, open yor mout make yu chop wetin I go give yu.”
John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop.
Una go bi my friend if una do wetin I tok.