Jeremaya 13:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
17 But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”
Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine
Den di pipol remember as e bi before; dat time wen Moses take dem komot from Egypt, so dem ask, “Where di God wey save en pipol from di sea? Where di God wey give Moses en Spirit?
I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.
But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.
“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.
Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
E nor keep ensef klean or tink of wetin go happen to am. Naw, e dey inside gutta and nobody won bring am out. So e kry kon sey, “Oga God, make Yu si wetin dey happen to mi; my enemies don win mi.”
Jerusalem wall wey fine well-well, make yu kry give God! Both day and nite, make di wota from yor eye dey flow like river! Make yu nor rest or stop to kry!
Just as sheep wey dem won offa as sakrifice dey full Jerusalem before di feast, na so too pipol go full di town wey bin dey empty. Den evribody go know sey na mi bi God.”
“Make yu pass thru evriwhere for Jerusalem kon mark di pipol front head; pipol wey dey face trobol and wahala, bikos of all di bad tins wey dey happen for di town.”
Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.
“I dey regret sey I make Saul king, bikos e don turn from mi and e nor do wetin I sey make e do.” Samuel kon vex well-well and e pray to God till day break.