Jeremaya 13:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
12 Di Oga wey bi Israel God kon tell mi, “Jeremaya, if yu tell Israel pipol make dem pour wine full dia wine pot, dem go ansa yu, ‘Yes! Wi know sey wine suppose full awa pot.’
Just as nika fine and dey tight pesin for waist, na so I wont make Israel and Jerusalem pipol whole mi tight. So dat dem go bi my pipol wey go dey praiz and honor my name; but dem nor gri obey mi.”
Den, yu go tell dem, ‘All di pipol wey dey dis land, God go give dem wine drink until di wine don katch dem: both di kings wey kom from David family, di priests, profets and all Jerusalem pipol.’