Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 12:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Den God ansa, “Jeremaya, if yu don taya to follow dis pipol run, how yu won take follow horse run? If yu nor fit stand for open land, how yu won take stay for forest near Jordan?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 12:5
14 Iomraidhean Croise  

For di first mont for di year, wen Jordan River dey flow enter land, dem kon cross go skata di pipol wey dey stay di valley, for di east and west side for di river.


I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.


If yu faint for di day wen wahala kom, dat one go show sey yor strent small well-well.


My pikin, if God korrect yu, listin well and take am as warnin.


Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”


So, as I just tok finish, dem kon seize mi dey shaut, “Wi suppose kill yu, bikos of dis rubbish wey yu dey tok so!


Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.


“Like lion wey run kom from Jordan bush kon katch sheep for fine betta land, na so too I go make Edom pipol run komot from dia kountry. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos e nor get anybody wey bi like mi and nobody fit shalenge mi! Wish ruler fit go against wetin I tok?


Like lion wey kom out from bush near Jordan, na so too, mi wey bi God go kom attack and porshu Babilon pipol komot from dia town. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos nobody bi like mi and who go fit shalenge mi? Wish ruler fit follow mi make mout?


Wen doz wey karry di Kovenant Box rish di river kon enter di wota (Jordan River dey rush well-well, bikos na harvest time dem dey),


My friends, make una nor sopraiz sey una dey pass thru trobol like pesin wey fire dey burn, bikos tins wey go make una fear, go must happen.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan