Jeremaya 12:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 Na Yu plant dem like tree kon make dia rut strong for groun and dem dey grow and bear betta fruit. Dem dey always tok about Yu even doh dem nor kare about Yu.
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
Mi, God wey dey mighty, na mi kreate una for Israel and Judah and I go bring wahala kom meet una. Yes! Na una kause dis wahala for unasef, bikos una don sin; una make mi vex wen una offa sakrifice give Baal juju.”
But God tell mi Jeremaya, “Make yu go tell Baruk sey, ‘I go soon skata wetin I build kon rut wetin I plant. I go do like dis for evriwhere for di world.
So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.
Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?
Jesus ansa dem, “Di tin wey Profet Isaya profesai about una, na true, bikos una dey pritend, as dem rite for God word, “ ‘Dis pipol dey praiz Mi with dia mout, but dia heart dey far from Mi.
Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.