Instead, dem go swear sey, ‘I bi di God wey bring Israel pipol kom out from di land wey dey nort and from all di oda kountries wey I skata dem go.’ Yes! I go bring dem kom back to dia own kountry; di land wey I give dia grand-grand papa. Mi, wey bi God, don tok.”
Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon. Mi, wey bi God, don tok.’
God sey make I go tell Israel pipol for nort sey, “Una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi. I go sorry for una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever.
Wen dat time rish, pipol go know Jerusalem as ‘God Throne’ and all di nashons go gada kom woship mi for der. Dem nor go do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do again.
den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”
But en kingdom go skata at wons go di four korna for di world and four oda kingdoms go raiz and nor bi en shidren or family pipol go rule dis pipol and di kingdoms nor go get pawa like en own.
I go bring my pipol kom back to dia land. Dem go ribuild dia towns wey skata kon stay der again; dem go plant vine kon drink di wine; dem go plant food for dia farm kon chop wetin dem plant.
Una must fight until God make una pipol win, just as E do for una and dem go kollect di land wey God give dem for di oda side for Jordan River. Den una fit go back to una own land wey I don give una.”