Jeremaya 12:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
13 My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”
Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.
I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.
Even wen una plant, una nor go harvest anytin. Una go press una olive fruit, but una nor go get enough oil to anoint unasef. Una go mash di grape, but una nor go get any wine to drink.
But make una dey sure about dis! Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok: Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin; all dia work go dey yuzles.
Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.
“Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.