Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
So, I go give dia wifes to oda men kon give dia farm to oda pipol. I go do am, bikos both rish and poor pipol dey use wayo take dey get dia money. Even profets and priests don join dey deceive pipol too.
Di priests dem bi like tif wey hide for bush bikos one attack pesin. Dem dey kill pipol for di road wey dem dey pass go Shekem and dem still dey do many wiked tins!
Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”