Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 11:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 11:19
28 Iomraidhean Croise  

Yu nor fit si wisdom with human being; bikos e nor dey among pipol wey dey alive.


Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.


Evil nor go fit kill doz kind pipol. Pipol wey dey raitious and good, pipol dey always remember dem.


I dey waka for God present as I dey for dis world!


Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.


But where I for dey naw, if to sey I nor bilive sey God go favor mi for dis land wey wi dey?


I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.


But wen I fall, dem go dey happy kon gada demsef togeda dey dance. Dem gada togeda to kause wahala for mi and dem nor gri stop or taya.


But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.


Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”


Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do, but dem go soon forget wiked pesin forever.


Make yu nor bi like wiked pipol wey dey plan to tif from good pipol or break enter dia house,


Small time, e bigin follow am like melu wey dem won go kill and like animal wey waka fast enter trap


Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.


I bin tink sey, I nor go ever si God or anybody wey dey alive again for dis world.


Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu. Mi, wey bi God, don tok.”


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


So, as I just tok finish, dem kon seize mi dey shaut, “Wi suppose kill yu, bikos of dis rubbish wey yu dey tok so!


Yu don si all dia plans to revensh mi.


“Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.


“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.


Na di profet dey wosh ova Israel for God. But anywhere wey e go, una dey won katch am like bird. Even for God house, all di pipol hate am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan