Jeremaya 11:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
16 I don first koll una olive tree wey get many fine fruit and leaf. But naw, I go kom like tonda kon put fire and e go burn di leaf, den break di branches dem.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”