Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 10:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dat kind juju bi like image for farm where dem plant melon put. Di juju nor dey tok; dem must karry am waka, bikos e nor get leg. But make una nor fear dem, bikos dem nor go fit wound or help una.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 10:5
16 Iomraidhean Croise  

So dem take one melu as Elijah tok kon kill-am put on-top di firewood wey dem arrange. Dem koll dia juju, Baal name from morning go rish aftanoon kon dey sey, “Baal! Make yu ansa us o-o.” But e nor ansa dem, even as dem dey jump anyhow for di altar wey dem make.


God vex for King Amazaya, so E send one profet go meet and tell am, “Why yu dey follow doz gods wey nor fit save dia own pipol from yor pawa?”


Moab pipol prayer nor go mean anytin, even wen dem klimb di hill go dia juju temple go pray and kry!


God sey, “Una wey survive for di nashons, make una gada kom! Pipol wey dey waka for evriwhere with di wood juju wey dem dey serve kon dey pray give oda gods wey nor fit save dem, nor know anytin at-all!


“Bel and Nebo town don fall. Dem pak dia juju on-top donkey and naw, di juju too heavy for di donkey to karry.


Dem go karry am for dia shoulder dey waka kon go put am for where e go dey. E nor go fit komot for where dem put am. Even wen pesin pray to am, e nor go fit ansa or save di pesin from wahala.


All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.


Curse dey una head! Una dey tell ordinary wood and stone sey, ‘Make una wake-up kon save us!’ Juju go fit tell una anytin? Dem fit make am with silva and gold, but e nor get life at-all.


I won make una remember sey, before una bigin follow Christ; na juju una dey serve.


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


For der, una go woship gods wey pesin take hand make; wood and stones wey nor go ever fit si, hear, chop or smell.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan