Jerusalem wey dey on-top di valley like rock wey high well-well, make yu listin to mi. I go fight against yu, bikos yu sey, ‘Nobody go fit attack or skata awa town.’
Benjamin pipol, make una run for una life! Make una run komot from Jerusalem! Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem, bikos wahala and distroshon dey kom from nort.
Dem go attack una towns until all di strong walls, (di walls wey una trust sey go protet una) go fall rish groun. Dem go attack all di towns for di land wey di Oga una God don give una.