Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.
kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”
God wey get pawa go bless dem kon sey, “Egypt wey bi my pipol, I go bless una. Assyria pipol wey I kreate and Israel pipol wey I don choose, I go bless una well-well too.”
Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.
God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”
Yu don show betta love to many-many pipol and Yu don still ponish pipol, bikos of dia papa and mama sin. Yu bi great God wey get pawa well-well and Yu dey rule evritin.
Mi, God wey dey mighty, I bi king. Na mi bi di God wey dey alive. As Mount Tabor high pass di mountins and Mount Karmel high pass di sea, di enemies wey dey kom attack una, na so dia pawa bi.
But di Pesin wey go save dem, dey strong. Dem dey koll am Oga God wey dey rule ova evritin. E go fight for dem kon bring peace and rest kom di eart, but na trobol, wahala and pain go follow Babilon pipol.”
“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”