Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 10:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Israel pipol, make una listin to wetin God dey tell una.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 10:1
16 Iomraidhean Croise  

Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.


My pipol, make una listin as I dey tok. Israel pipol, dis na wetin I get against una, na Mi bi di Oga wey bi una God!


So Sodom leaders, make una listin to wetin God dey tell una. Gomorrah pipol, make una put ear for wetin God dey tish una.


So, all di sturbon and wiked rulers for Jerusalem, make una listin to wetin God dey tok.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.


Di Oga una God sey, “Make una nor do wetin oda nashons dey do; make una nor let doz signs for sky disturb una mind, even if oda nashons dey fear am,


Naw, Jakob shidren-shidren and Israel family, make una listin to God word.


‘Judah king wey sidan for David throne, en ofisas and all en pipol wey dey pass dis gate, make una listin.


If una wey remain for Judah do like dat, den make una hear wetin Israel God dey tok, ‘If una don gri sey una won go stay for Egypt,


I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”


Israel pipol, make una hear wetin God dey tok! God dey akuiz evribody for Israel sey: “For dis land, nobody love mi, dey faithful or si mi as en God.


So naw, make yu listin to wetin God tok. Yu sey make I stop to profesai and warn Israel pipol; make I nor prish against Isaak family, abi?


Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan