Bikos mi wey bi God go tok anytin wey I like and e go happen, just as I tok am: E nor go waste time again and na wen wiked pipol still dey alive. Yes! I go tok di word and e go happen just as I tok am.’ ”
So make yu tell dem, ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Evritin wey I tok, nor go tey before dem go happen! Evry word wey I tok, go must happen.’ ”
E kon ask mi, “Amos, wetin yu dey si?” I ansa, “Na ruler.” Den E sey, “I go test my pipol with dis ruler. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
God kon ask mi, “Amos, na wetin yu dey si?” I ansa, “Na basket wey fruit full.” Den God tell mi, “Di end don kom for my pipol, Israel. I nor go shange my mind again and I go ponish dem.
E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.