Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jenesis 5:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Na both man and woman E kreate kon bless and koll dem, “Human being.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jenesis 5:2
9 Iomraidhean Croise  

So God kon kreate human being like ensef; as God bi, na so E kreate dem; both man and woman, na-im E kreate.


God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”


God take man kon put am for Eden Gardin, so dat e go kare for evritin.


Den di man sey, “At last, dis one bone kom from my bone and en flesh kom from my flesh; I go koll am, ‘Woman,’ bikos God make am from man.”


Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.


God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.


Jesus ansa, “Yu neva read am from di biginnin sey na man and woman God make


But from di time God kreate di world, na man and woman naim E make.


Na thru one man E make all di tribes wey dey di world and E tok di time and place where dem go find God rish,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan