Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jenesis 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 While Abel bring some of di first-born for en animals wey fat pass. God like wetin Abel bring,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jenesis 4:4
22 Iomraidhean Croise  

Wen evening rish and day don dark, one pot wey dey bring smoke with fire and dey shine like tosh kon pass between di animals wey Abram sakrifice.


Afta sometaim, Kain kon bring some fruit from di groun wey e won offa give Oga God.


Una go koll una god name and I go koll my God name. Den, di one wey go ansa with fire, na-im bi di true God.” All di pipol ansa, “Dis test na good one.”


At wons, fire from God kon fall from heaven. Di fire burn di ofrin, di wood, di stones and di dirty kon dry di wota wey dey di gutta.


E build altar for der for God kon do burnt and fellowship ofrin for di altar. E pray and God kon ansa am, bikos E send fire from heaven kon burn di sakrifice for di altar.


Wen Solomon don pray finish, fire kom down from heaven kon burn di ofrin and di sakrifice, den God present kon full inside di temple.


Make E remember all di gifts wey yu gi-am, den favor yu, bikos of yor ofrins.


una must give all di first-born wey bi man, both human being and animals to Oga God.


Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


At wons, God send fire go burn di burnt ofrin and di fat dem for di altar. Wen di pipol si am, dem kon shaut and bow face groun.


Moses vex well-well kon tell God, “Make Yu nor asept dia ofrin. I nor tif dia animal or do any bad tin against dem.”


Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.


“I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.


“But make yu nor take money for di first-born for melu, sheep or goat, bikos dem dey holy. Yu must kill and sprinkol dia blood for di altar kon burn dia fat for di ofrin wey dem make with fire wey get betta smell to God.


Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith.


True-true, akordin to di law, na almost evritin blood dey make klean and if dem neva pour blood, God nor go forgive dem dia sins.


Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.


God angel tosh di meat and bread with di stik wey e hold and fire kom out from di rock kon burn di food finish. Den di angel disappear.


Den Samuel sey, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice? E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan