Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jenesis 26:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Honga kon dey di land, just as e happen for Abraham time. So Isaak kon go Gerar where Abimelek wey bi Filistia pipol king dey stay.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jenesis 26:1
10 Iomraidhean Croise  

But honga kon dey di land, so Abram go Egypt go stay der small, bikos di honga strong well-well.


Afta Abraham don die, God kon bless en pikin Isaak. Isaak dey stay near Beer Lahai Roi.


Den Jakob give Esau some bread and stew; Esau chop kon drink wota den e get up waka komot der. Na so Esau take sell en rite as senior give Jakob.


So Israel shidren follow di oda pipol kon buy food for Egypt, bikos di honga strong well-well for Kanaan land.


Naw di honga strong well-well.


Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”


God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’


For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan