3 God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.
So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.
For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest.
Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate.
Yu tish dem sey make dem keep di Sabat Day holy kon give dem yor laws thru yor savant, Moses.
“Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.
“Una go work for six days, but for di sevent day, una must rest; even if na wen una dey prepare una land to plant or harvest.
Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.
I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.
“ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.
Jesus tell dem, “God make Sabat Day to help pipol, but nor bi sey make Sabat Day kontrol pipol life.
Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.