Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




James 5:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




James 5:6
24 Iomraidhean Croise  

Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent, bikos dem don take bribe.


Dem trit and ponish am anyhow, but e put body down kon bear-am like lamb wey dem won go kill and e nor tok anytin.


“But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’


But di priest oga dem and di eldas sey make di pipol ask for Barabas, so dat dem go fit kill Jesus Christ.


But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too.


Den e sey, ‘God wey awa grand-grand papa dem serve don already choose yu to do wetin e wont, so dat yu go take yor eye si di Raitious Pesin. So make yu hear and listin to am,


E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’


Na di place wey e dey read for God word bi dis, “Dem lead am like sheep go kill and as sheep pikin dey kwayet wen dem dey shave am, na so too e nor open en mout.


My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.”


But una nor dey respet poor pipol! Nor bi rish pipol dey opress and drag una go kourt?


Yu wont sometin, but yu nor get am; yu dey kill, dey wont wetin oda pipol get and yu nor dey fit get am; so yu go kon dey kworel and fight. Yu nor get, bikos yu nor ask God make E give yu.


If e go hard for God pipol to dey save, den e nor go eazy for doz wey nor dey fear God.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan