Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




James 5:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




James 5:4
23 Iomraidhean Croise  

But di Oga God sey, “Wetin yu don do so? Yor broda blood dey kry from groun kon meet mi!


Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.


Like savant wey dey wait make nite kwik kom; like worker wey dey wait make dem pay am.


Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.


bikos dat na di only klot wey una neighbour get to wear, so dat kold nor go katch am. E get any oda klot wey e go take sleep? And wen e kry kon meet mi, I go listin to am, bikos I dey pity for pesin well-well.


True-true, Israel pipol kry don rish my ear and I don si how Egypt pipol dey sofa and opress dem.


If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


God wey dey lead heaven sojas sey, “One day, all dis big fine house go skata and nobody go stay inside again.”


“E go bad for di king wey build big house with lie-lie and wayo. Di king wey make di men dey work for nor-tin and nor gri pay dem dia salari.


Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.


Even di stones for wall and ceiling dey kry and komplain against una.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


Den e tell en disciples, “Wetin pipol go harvest plenty well-well, but di pipol wey go do di work nor plenty rish.”


una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?


Just as Profet Isaya tok before sey: “If to sey God Almighty nor save some among awa shidren, wi for don die finish like Sodom and Gomorrah.”


Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.


Una wey bi masta, make una trit una savants well and nor shit dem, bikos una know sey, unasef get masta for heaven.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan