Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’
bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.
As e karry ensef up, dey enjoy yeye life, na so di sofa and sadnes wey yu go gi-am, go plenty rish, bikos e tok for en mind sey, ‘I dey rule like kween, my husband neva die and I nor go ever si sadnes again!’