Di king kon sey make dem koll Abraham kom. Wen dem koll am kom, di king kon tell am, “Wetin bi dis wey yu do so? Na wish kind bad tin I do yu, wey yu won make mi and my kingdom kommit dis kind big sin? Yu don do sometin to mi wey yu nor suppose do!”
Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”
bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.