But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.
Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”
Make una nor opress wimen wey dia husband don die; shidren wey nor get papa and mama; strenjas wey dey una town; doz wey nid una help and make una nor plan bad against each oda.’
But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.
Wen dem nor si dem, dem kon drag Jason and some for en brodas go meet di town oga, dey shaut, “All dis pipol wey don start wahala for di world, don rish here too
Una nor get house wey una go for chop and drink? Abi una hate God church? Una won disgrace pipol wey nor get anytin to chop? Wetin I go fit tell una naw? I nor go fit praiz una at-all.
Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.