Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!” But di pipol nor tok anytin.
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.
E tok about dis tins for all en letas. Aldo some tins for di leta dey hard to undastand and doz wey nor know di trut or dey stabol, don turn dem to wetin go kill dem. Na so dem take distroy all di oda part for God word too.