Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.
Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.
Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.