One vois dey kry sey, “Make yu prish one message!” So I ask, “Wish message I go prish?” Di vois ansa, “Make yu prish sey all men na grass; let dem know sey dem nor dey last pass flower wey dey bush.
Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.
If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.
E nor go make any difrence even if yu get all di tins for dis world or sey yu like di world well-well, bikos as wi know, di world go soon vanish komot.
Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.