Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Isaya 8:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Before di pikin go big rish to sey, ‘Papa or Mama,’ all Damaskus propaty and di tins wey dem karry from Samaria, Assyria king go kom karry dem go.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Isaya 8:4
16 Iomraidhean Croise  

Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.


Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.


King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.


Dis message na about Damaskus pipol, “Si, Damaskus town go disappear and e go turn where dem dey trow dirty put.


Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


Di proud leaders glory wey don dey fade, go disappear like di first fig wey kom out for en sizin; pipol go plok dem chop wen dem neva ripe.


God tell mi again sey,


God sey, “Damaskus pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem flog Gilead pipol with stik wey get iron tit.


I go skata Damaskus town gate; I go remove di ruler from Aven Valley kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden. Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.” Dis na wetin God tok.


den why yu feel sey I know go sorry for Nineveh town wey dey for darkness? Place where en pipol many pass one hundred and 20,000 and wey get many animals.”


Even before dem born di shidren or sey dem do any bad or good tin, God tell Rebekah, “Di senior pikin go serve en junior broda, so dat my promise go stand:


Una shidren wey una feel sey go die for road, di ones wey nor know good from bad, na dem I go give di land to. I go give dem di land and e go bi dia own forever.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan