Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Isaya 7:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 So God tell Isaya, “Make yu take Shear-Jashub yor pikin go meet King Ahaz. Yu go si am for di side where wota for dey kom di pool, where pipol for dey wosh klot.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Isaya 7:3
14 Iomraidhean Croise  

For seventeen years wey Remalaya pikin, Pekah dey rule, Jotam pikin, Ahaz kon bi king for Judah.


Assyria king send en sojas oga, di kourt oga and di adviser with many sojas from Lakish go meet King Hezekaya for Jerusalem. Wen dem rish der, dem kon go stand near di wota wey dey for di road wey dem dey pass go di field where dem for dey wosh and dry klot.


Di remainin tins wey Hezekaya do, plus all wetin e get and how e build pool where wota go from dey kom di town, dem rite am put for Judah kings history book.


Nehemaya wey bi Azbuk pikin, wey dey rule half of Bet-Zur aria, ripair di next side go rish David Grave, with di pool and di Sojas House.


So make yu prepare yorsef go meet am for morning wen e dey go River Nile korna and make yu hold di stik wey shange to snake for yor hand.


Some of dem go kom back! Yes Jakob shidren wey remain go kom back to dia God wey get pawa.


Una kount di house for Jerusalem kon skata some house, so dat una go fit si tins wey una go take ribuild di walls.


Una make somewhere inside di town where una go dey store wota wey dey flow kom from di old pool. But una nor trust God wey make am. Una nor gri depend on God wey make all dis tins.


Den e kommand en offisa oga sey make e karry plenty sojas from Lakish go Jerusalem kon tell King Hezekaya sey make e surenda. So, di ofisas take-ova di road where di pipol for dey wosh and dry klot, near di Uppa Pool.


Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.


Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land, dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy. Dis holy tin, na di special family wey God choose.”


God tell mi, “Make yu go Judah king palis kon tell am dis message:


And dis na wetin Profet Isaya tok about Israel pipol, “Israel shidren many like san-san wey dey wotaside. But na few of dem, God go save.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan