Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Hibru 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Bikos di message wey God tok thru en angels, na trut and anybody wey disobey di law, God go ponish am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Hibru 2:2
29 Iomraidhean Croise  

Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai, E kom with angels and shariot wey nobody fit kount.


As dem still dey chop di meat, God kon dey vex with di pipol, so E send sickness go meet dem.


Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter.


So God send snake go bite di pipol and dem many wey die.


Doz wey die for di wahala na 24,000.


Na una receive God law wey E send thru en angels, but una nor obey am.”


Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.


Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.


Wen una don dey stay di town wey di Oga una God go give una, if one man or woman among una do bad tin for God eye kon go against en kovenant,


den make una take di man or woman wey kommit dis sin go outside di town gate kon stone am die.


Anybody wey nor gri obey or keep dis law and kommand, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.” ’ ”


Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; make wetin I dey tok bi like dew for morning. Make my words fall like rain on-top grass and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.


Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets,


Wen two or three pipol bi witness sey somebody rijet Moses Law, dem go kill-am without sey dem sorry for am.


So make una always dey strong, bikos una go get betta reward.


E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward.


Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.


Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?


Afta dat one, wi bilive wetin di profets prish. Una go do well if una hear and follow di lite wey dey shine for darkness and wen day break, di star wey dey kom for morning, go shine for una heart.


So I won remind una even doh una don already know dis tins. Afta God don first save Israel pipol from Egypt, e kon distroy doz wey nor bilive am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan