Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Haggai 1:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 “Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Haggai 1:9
25 Iomraidhean Croise  

Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”


Di river dry finish and di eart foundashon kon open so God nor keep silent and E kon shaut for en enemies with vexnashon.


God go put one kind spirit for inside am wey go make am hear rumor, den e go-go back to en own kountry, den God go kill-am for der.’ ”


I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’


Wen pipol give out dia money, dem dey get more; but doz wey nor dey give, nor dey get at-all.


Just as grave nor dey taya to take dead body, na so too di tins wey pipol wont for dis world, nor dey satisfy dem.


All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.


Grass dey dry and flowers dey fade wons God send strong breeze go blow dem. Na so too pipol nor dey last pass grass.


True-true, big vineyard go produce only five gallon of wine and ten basket of seed go produce only one basket of good korn.


My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”


Una go feel my vexnashon like hot fire. And I go give una to wiked men wey sabi distroy tins.


Den for di fift year, una fit chop di fruit wey e bear kon add am join una harvest. Na mi bi di Oga una God.


“My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”


Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.


Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.


Una go plant plenty seed, but na small tin una go harvest, bikos siti-siti go chop evritin wey una plant.


But dis na wetin I get against yu: di way yu love mi naw, nor strong rish as e bi before!


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan