Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Filippians 2:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Make una nor dey karry body up, but make una trit each oda like unasef. Instead, una dey do wetin una like, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Filippians 2:3
24 Iomraidhean Croise  

To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.


“I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”


Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef.


So make wi dey bihave well as pipol dey do for day time. Nor go anyhow party or drink too mush, den kon dey bihave anyhow. Nor kworel or judge pipol.


But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.


bikos na mi small pass among all di apostles. But, I kause many wahala for God church, so dem nor suppose koll mi apostle.


bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.


Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.


But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake.


Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.


Make una dey get pity for one anoda with kwayetnes, gentolness and patient, bikos of di love wey una get.


Bikos of di respet wey una get for Christ, make una dey respet one anoda.


Make una nor use vexnashon take work for God,


So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.


but naw, to dey vex anyhow; to get bad mind for pesin; to take mout spoil pesin and to dey curse pipol, make una remove dem from una life.


dat pesin dey proud and na only to dey argue and kworel, e know. Dis kind tin nor good, bikos jealousy; kworel; lie-lie; to dey suspet odas anyhow


So, make una live for peace togeda, dey sorry for each oda; love one anoda and nor dey karry body up.


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan