Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Filippians 1:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 bikos of how una dey help mi prish di gospel from di first day wey una hear am kon rish today.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Filippians 1:5
23 Iomraidhean Croise  

Dem kon dey use all dia time dey learn wetin di apostles dey tish. Dem dey waka, help, chop and pray togeda.


Gentile pipol, una bi like branches wey dem add join olive tree. Una don take di place for some branches wey God first kut komot. So una dey enjoy di blessings, wey di rut dey give.


Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.


bikos God pipol for Masidonia and Akaia give mi money make I give di poor Christians for der.


God dey faithful, bikos na-im koll una to waka with en pikin, Jesus Christ wey bi awa Oga God.


Awa brodas and sistas, wi don tell una about di grace wey God give di pipol for di church for Masidonia sey,


So, bikos of di gospel, Gentile pipol don follow Jew pipol get share for God blessing. Dem don bi membas for Christ body and dem get share for God promise.


My brodas and sistas, I wont make una know sey my sofa na to make di gospel stand.


I know sey dis ones na love make dem dey do am, bikos dem know sey I dey here to defend wetin dem dey prish.


Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.


So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.


So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well,


Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.


Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.


So, if yu si mi as yor broda and patina, make yu asept am as yu go take asept mi.


Bikos wi go bi Jesus Christ friend, if wi whole awa faith strong go rish di end.


Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.


Na wetin wi don si and hear, wi dey tell una, so dat una go fit bi awa friend, just as wi bi friend with di Papa and en Pikin.)


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan