4 Evritime wey I remember yu for my prayers, I dey tank my God,
Today, I tank my God thru en pikin Jesus Christ for all of una, bikos na for di whole world dem dey tok about how una faith for God strong rish.
I nor dey stop to tank God for una, wen ever I dey pray.
I dey tank my God evritime I remember una.
Wi dey always tank God wey bi Jesus Christ Papa, anytime wen wi dey pray for una,
Wen ever wi dey pray, wi dey always tank God for all of una.
Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too.
Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.
bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,