Make una greet my kousin Andronikus and Junia wey dey prison with mi before. Di apostles dey respet dem and dem too don dey follow God, before I even know Christ.
Aristakus, wey follow mi dey prison dey greet una and Mark wey bi Banabas kousin (wey wi bin tell una sey, if e kom meet una, make una welkom am) dey greet una too.
Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.