11 Before, e nor dey yuzful to yu, but naw, e dey yuzful to mi and yu.
Make una trow dat wiked savant inside darkness for outside, where e go kry and grind en tit.’
bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.
But e good make I do party, bikos yor broda die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, wi don si am.’ ”
Na so too e go bi with una. Wen una don do all wetin dem send una, make una sey, ‘Na savant wi bi, wi nor rish make dem praiz us, bikos wi just do wetin wi suppose to do.’ ”
Evribody don turn leave God, all of dem don bi yeye for God eye. Nobody dey do wetin good at-all.
Na only Luke dey with mi. Make yu karry Mark follow body wen yu dey kom, bikos e go fit help mi for di ministry work.
Abeg, make yu dey kind to Onesimus, wey bi my pikin for God work and e dey prison with mi.
I dey send am kom back kom meet yu (even doh I love am well-well).
Before-before, una nor bi God pipol, but naw, una don bi en pipol. Dat time, God nor get mesi for una, but naw, una don get en mesi.