Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Daniel 8:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 I look up kon si one ram wey get two horn and e stand near di river. Di two horn long, but one long pass di oda one. Di one wey long pass, kom out afta di short one.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Daniel 8:3
25 Iomraidhean Croise  

David si as di angel stand for di centre; hold en swod as e bin won distroy Jerusalem finish.


Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.


Dem still go bribe Persia ofisas, so dat dem go attack Judah pipol. Dem kontinue to dey do like dis thru-out di time wey Cyrus dey rule and dem do am enter King Darius time.


and for di third year wen e dey rule, e kon do party for all en ofisas and savants. Di sojas for Persia and Media dey der too, with di ofisas and strong men for di kountries.


God sey, “I go make Medes pipol attack Babilon pipol. Dem nor dey kare about silva and nobody fit tempt dem with gold.


I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”


Na mi tell Cyrus sey, ‘Na yu bi di pesin wey go rule; yu go do wetin I wont make yu do. Yu go orda make dem build Jerusalem again kon ribuild di Temple.’ ”


So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!


I look up kon si one man wey wear linen klot: di belt for en waist na gold wey dem make from Ufaz.


But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.


Darius wey bi Media pipol king kon take-ova di kingdom and dat time, e bi sixty-two years.


Wen Darius still dey rule for Babilon and Cyrus dey rule for Persia, Daniel kom prosper well-well.


“Di sekond beast bi like bear. Dem karry am for one side. E get three rib for en mout and dem dey en tit centre. So I hear wen one vois tell am, ‘Get up make yu go chop pipol until yu beleful.’


For dis vishon, I si mysef for Shushan wey dey Elam aria. As I stand near Ulai river,


Di ram wey yu si wey get two horn, na di two kings for Mede and Persia.


Den wen I look up again, I kon si four horns.


Den I look again kon si one man whole ruler wey dem take dey measure.


I look up again and I kon si one book dey fly for di sky.


Leta, di angel kon tell mi again, “Make yu look! Anoda tin dey kom!”


I look up again kon si two wimen dey fly kom meet us and dem get strong feada like bird own. Dem pick di basket kon fly go with am.


I look up again and dis time, I si four shariot dey kom out from di centre for two bronze mountin.


As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.


Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”


Den I si anoda beast dey kom out from groun. E get two horns like small sheep own, but e dey tok like dragon.


Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan