Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.
But en kingdom go skata at wons go di four korna for di world and four oda kingdoms go raiz and nor bi en shidren or family pipol go rule dis pipol and di kingdoms nor go get pawa like en own.
“Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”
For dat same year wen e dey rule, mi Daniel kom undastand di holy book wey sey na seventy years God tell Profet Jeremaya sey, Jerusalem pipol go skata for di world.