Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Daniel 7:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 “Di sekond beast bi like bear. Dem karry am for one side. E get three rib for en mout and dem dey en tit centre. So I hear wen one vois tell am, ‘Get up make yu go chop pipol until yu beleful.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Daniel 7:5
14 Iomraidhean Croise  

So Elisha turn look dem kon curse dem with God name. Den two woman bear kom outside from di wood kon kill forty-two of di boys.


E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.


God don tell di oda nashon make dem kom like wiked animals kon skata en pipol.


And na di trut I won tell yu naw.” Di angel still sey, “Three more king go kom from Persia. Den di fourt king go get money well-well pass all di kings wey don dey before am. Wen e don get pawa well-well, bikos of en money, e go karry evribody go fight Greece.


But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.


Farsin (division) mean sey: ‘Dem go divide yor kingdom give Mede and Persia pipol.’ ”


“Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.


“Afta all dis tins, as I dey look, anoda beast wey bi like leopard kon kom out with four feada for en back, di feada bi like bird own. Dis beast get four head and dem kom gi-am pawa to rule.


I go attack una like bear wey en pikin lost kon tear una to pieces. As lion and wiked animals dey distroy tins, na so too I go distroy una.


Di beast wey I si, bi like leopard, but en leg bi like bear leg and en mout bi like lion own. Di dragon kon gi-am pawa, en throne and strong authority to rule.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan